9 and dia feadas dey tosh each oda. Each one dey waka go strait and dem nor dey turn as dem dey waka.
Wen dem dey move, dem fit go any of di four direcshon wey dem face and dem nor dey turn as dem dey move.
Di creatures fit go anywhere without sey dem turn. Dem dey go di direcshon wey dem like without sey dem turn.
Dia face just bi like di face wey I si for Chebar River. Each creature just dey waka strait dey go.
Wen di time wey God go take Jesus go heaven don near, Jesus tink for en mind sey, e go-go Jerusalem.
Jesus tell am, “Pesin wey put hand for dis work, den e kon dey look back, nor get part for God Kingdom.”
My brodas and sistas, I dey beg una with awa Oga God Jesus Christ name sey, make una nor kworel, but make una get one mind for evritin wey una dey do.