7 Fero kon send pipol go find out and true-true, Israel pipol animal nor die. With all dis tins wey dey happen so, Fero heart still strong and e nor gri free di pipol.
God too get sense and en pawa dey mighty; nobody fit stand against am.
“But I know sey Egypt king nor go let una go, unless I force am.
With all dis ones, Fero heart still strong well-well and e nor gri listin to dem, just as God tok.
God tell Moses, “Fero heart dey strong and sturbon and e nor go gri allow di pipol go.
But Fero heart still dey strong and sturbon as before and e nor gri free di pipol.
But God still make Fero heart strong and e nor gri listin to dem, just as Oga God sey e go bi.
Den Oga God tell Moses and Aaron sey, “Make una gada ashes from where dem for dey burn firewood, den make Moses blow dem for air for di king front.
If yu nor dey gri take korreshon, one day yu go fall and yu nor go fit stand again.
Bikos I know how una sturbon rish; una neck strong like iron and una head bi like bronze.
But e kom dey karry body up, dey sturbon and pride kon full en spirit, so God remove am from en throne and e kom lost en respet.
So, God dey sorry for who E won sorry for and dey ponish who E won ponish.