So dem bring all dia animals kon give Josef and Josef give dem food afta dem don drop dia horse, sheep and kattle. E save dem dat year, bikos e still dey give dem food chop wen dem bring dia animals.
Moses and Aaron kon sey, “Hibru pipol God don show ensef to us. So make yu allow us go di wildaness for three days go do sakrifice to awa God, so dat E nor go kill us with sickness or war.”
Fero nor go gri listin to una. So I go ponish Egypt pipol. I go use force take karry my pipol Israel komot from Egypt land, den judge Egypt pipol well-well.
“I send diziz kom meet una like di one wey happen to Egypt pipol. I kill una yong men for war kon skata una horse. I allow dead body dey smell for una kamps, but una nor still gri turn kom meet mi.” Na so Oga God tok.
Naw, God don raiz en hand against yu. Yor eye go blind and yu nor go fit si for sometaim!” At wons, e eye just blind and darkness kover en face and e kon dey take hand find pipol make dem show am road.
But make una dey look am. If only di truck go by ensef to Bet-Shemesh borda, den make una know sey na God give una dis big wahala. But if e nor go like dat, den wi go know sey nor bi en dey give us dis wahala; instead, e just happen to us like dat.”