Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 8:32 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

32 But Fero heart still dey strong and sturbon as before and e nor gri free di pipol.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 8:32
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God tell Moses, “Wen yu go back to Egypt, yu must do all dis mirakle and sign for Fero front, bikos I don put pawa for yor hand. But I go make Fero heart strong well-well and e nor go gri free my pipol.


But wen Fero si sey di wahala don end, en heart kon strong more and e nor gri listin to dem, just as Oga God tok.


and Oga God do as Moses ask. E remove all di fly from Fero, en savants and en pipol.


Den Fero koll Moses and Aaron kon tell dem, “Make una pray to God make E remove all di frog from mi and my pipol and I go allow una go sakrifice to am for di wildaness.”


Fero kon send pipol go find out and true-true, Israel pipol animal nor die. With all dis tins wey dey happen so, Fero heart still strong and e nor gri free di pipol.


Why Yu make us komot from yor plans and ways? Why Yu make us sturbon like dat, sotey wi turn from Yu? Make Yu kom back, bikos of doz wey dey serve Yu and bikos of di pipol wey bi yor own.


But una sturbones and strong heart nor let una turn from sin kom meet God, so una dey make una ponishment many more-more, for di Day wen God go judge di world, bikos en na judge wey nor dey support bad tins.


Wetin make una dey sturbon like Egypt pipol and dia king? Wen God ponish dem, dem nor sey make Israel pipol dey go?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ