Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 8:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 But Moses sey, “Dat nor bi wetin wi suppose do, di kind sakrifice wey wi won do for di Oga awa God na wetin Egypt pipol dey forbid. If wi make sakrifice wey Egypt pipol dey forbid for dia face, dem nor go stone us die?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 8:26
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem arrange one place for am, anoda place for en brodas and anoda place for di Egypt pipol wey won chop with am. (Dis na bikos, Egypt pipol nor dey chop with Hibru pipol, bikos Egypt pipol bilive sey e nor good to chop with Hibru pipol.)


Den make una tell am sey, ‘Yor savants dey kare for animals since wi bi small pikin kon rish naw, both wi and awa papa.’ Make una tok like dat, so dat una go fit stay for Goshen land, bikos Egypt pipol nor like pipol wey dey kare for animals.”


Di king skata all di high place for Jerusalem east and Distroshon Mountin for sout, wey King Solomon build for Sidon pipol juju, Astarte and Kemosh di ashawo juju for Moab pipol, plus Ammon pipol juju wey bi Milkom.


Afta dem don do all dis tins finish, some among Israel leaders kom meet and tell mi, Di pipol, di priest and Levi pipol neva separate demsef from di pipol wey dey di kountries wey near dem. Dem still dey do tins with Ammon, Moab, Egypt, Kanaan, Hit, Periz, Jebus and Amor pipol. Dem dey do di same yeye tins wey doz pipol dey do.


“Di eldas go agri with yu, so yu and di eldas for Israel must go si Egypt king kon tell am, ‘God, wey bi Hibru pipol God don kom meet us. Naw, make yu allow us travel for three days go inside di wildaness, so dat wi go fit go offa sakrifice give di Oga awa God.’


Den Fero koll Moses and Aaron kon tell dem, “Make una pray to God make E remove all di frog from mi and my pipol and I go allow una go sakrifice to am for di wildaness.”


Dem nor tink or rizin sef sey, ‘I dey burn some of di wood take bake bread and roast meat chop. Yet, I dey use dis same wood make juju and woship am?’


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ