Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 8:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Di juju-men kon tell Fero, “Dis na God handwork!” But Fero heart still strong and sturbon and e nor gri listin to dem, just as God tok.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 8:19
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di tin ones kon swallow di fat ones. So I tell all my priest and majishan, but nobody fit tell mi wetin di dreams mean.”


Wen I look di sky for nite kon si di work wey Yu do; di moon and di stars wey Yu keep for dia place,


Nobody fit si each oda and nobody fit stand up komot for where e dey for three days. But Israel pipol get lite for where dem dey.


Fero savants ask am, “Na how long dis man go dey trobol us? Make yu free di pipol make dem go serve di Oga wey bi dia God. Yu nor know sey Egypt don distroy finish?”


But for Israel pipol side, peace go dey well-well, even dog nor go bark for anybody or animal, den yu go know sey Oga God don separate Israel pipol from Egypt pipol.


With all dis ones, Fero heart still strong well-well and e nor gri listin to dem, just as God tok.


Fero nor go gri listin to una. So I go ponish Egypt pipol. I go use force take karry my pipol Israel komot from Egypt land, den judge Egypt pipol well-well.


Den wen I show Egypt pipol as I strong rish kon take Israel pipol komot from der, di pipol go know sey na mi bi Oga God.”


But di ice-blok rain nor fall for Goshen land where Israel pipol dey stay.


But I go separate Israel animals from Egypt pipol own. No Israel animal go die.” ’


For nite, God show and tell Daniel evritin thru dream. Den Daniel praiz God wey dey heaven


But if na God Spirit I take dey drive demons, den God Kingdom don already kom meet una.


But if na God pawa I take dey drive demon komot, den God Kingdom don rish where una dey.


Den di priest oga dem and Farisee pipol kon koll di kansol memba dem togeda, ask dem, “Wetin wi go do, since dis man dey do plenty mirakles?


“Wetin wi go do about dis pipol? Bikos evribody wey dey for Jerusalem don know sey na big mirakle naim God use dem do so and wi nor go fit deny am.


Dem kon ansa, “If una won riton Israel God box go back to where e dey before, una must karry sometin join am. Una must put ofrin wey go show sey wetin una do nor good. Den una go dey well and una go know wetin make God dey ponish una.”


But make una dey look am. If only di truck go by ensef to Bet-Shemesh borda, den make una know sey na God give una dis big wahala. But if e nor go like dat, den wi go know sey nor bi en dey give us dis wahala; instead, e just happen to us like dat.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ