12 Moses and Aaron kon waka leave Fero. Den Moses pray to God make E remove di frog wey E send kon meet Fero.
Wen God tok, fly kon enter Egypt and worm kon full evriwhere.
So Moses komot from Fero front kon go pray to Oga God.
But Moses beg God kon sey, “My Oga! Why Yu dey vex with yor pipol wey Yu take komot from Egypt with great pawa and mighty hand?
God do as Moses wont and all di frog inside dia house, village and farms, kon die.
So Moses komot from where Fero dey kon go pray
Den Fero koll Moses and Aaron kon tell dem, “Make una pray to God make E remove all di frog from mi and my pipol and I go allow una go sakrifice to am for di wildaness.”
So Moses waka leave Fero kon go inside di town stresh en two hand go heaven as e dey pray and di tonda, di ice-blok and di rain kon stop to fall.
God wey get pawa sey, “I go allow Israel pipol ask mi for help and dem go plenty like sheep again.
As for mi, God forbid sey I nor go dey pray for una again, bikos dat na sin. I go tell una di tin wey dey good and wey dey make belle sweet God.