Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 8:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Fero ansa, “Na tumoro.” Den Moses sey, “E go bi as yu tok, so dat yu go know sey nobody bi like di Oga wey bi awa God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 8:10
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Oga God! Yu dey great! Nobody bi like Yu. Na only Yu bi God. Wetin wi don hear, na true!


My Oga God! Nobody bi like Yu! Wi know sey na only Yu bi God.


Den dem go know sey na only Yu bi God, di Pesin wey get pawa pass for di whole world.


My God, no oda god bi like Yu. No one fit do wetin Yu dey do!


Dem don know God naw, bikos E dey judge well and naw, wiked pipol dey fall enter dia own trap.


My Oga God! Who bi like Yu among oda gods? Who bi like Yu? Di One wey dey holy, wey dey do mirakles and great tins?


So Moses tell Fero, “I go dey happy to pray for yu, yor savants and yor pipol, so dat di frog go komot from yor land go back to di river. So na wish time yu wont make I pray.”


Bikos dis time, I nor go only ponish yor savant and pipol, but I go ponish yu too, so dat yu go know sey nobody bi like mi for di whole world.


Moses ansa am, “Wen I komot go inside town I go stresh my two hand go heaven to di Oga wey bi God, den di tonda go stop and di ice-blok nor go fall again, so dat yu go know sey na Oga God get di whole world.


Make yu nor boast about tumoro, bikos yu nor know wetin go happen between naw and den.


Who dem go fit use take kompare God? How yu go fit take diskribe who God bi?


Who dem go fit use take kompare God? E get anybody wey bi like am?


Make una remember wetin happen before-before! Na mi bi God and e nor get any oda god. Yes! Na mi bi God and nobody bi like mi.


“My Oga God, yu don start to show mi yor pawa and how Yu strong rish. (Na wish god for heaven or eart go fit do wetin Yu dey do so?)


Bikos awa enemies rock nor bi like awa Rock and even awa enemies know sey na so e bi.


Israel pipol, no god bi like una God. E dey kom help una from heaven and di sky with en wonderful pawa.


E show una dis tins, so dat una go know sey na di Oga God bi God and no oda pesin or tin, big rish am.


So make una remember dis tins kon keep am well for una heart: Na di Oga God bi God, both for heaven and for eart and know oda god, dey.


but yu nor know tumoro. Wetin yor life bi like? Yu bi like smoke wey dey kom out from fire. Pipol go si am, den small time e go vanish.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ