Moses and Aaron do as Oga God kommand dem. Aaron use di rod wey dey en hand take nak River Nile for where Fero and en savants dey and di river turn to blood.
But di juju-men for Egypt still do di same tin with dia juju pawa and dis tin kon make Fero heart strong more-more and e nor gri listin to Moses and Aaron, just as Oga God tell dem.
And wen dem divide evritin wey get life for di sea into three, one part die finish. Den wen dem divide all di ship for di world into three, one part burn finish too.