30 But Moses ansa, “Since I nor fit tok well, how Fero go take listin to mi?”
Moses ansa again, “Na wetin I go do if dem nor bilive or listin to mi, but kon dey sey, ‘God nor appear to yu’?”
Den Moses tell God, “My Oga God, Yu know sey I nor sabi tok well since dem born mi kon rish naw wey Yu dey tok to mi, yor savant.”
But Moses ansa, “If Israel pipol nor gri listin to mi, den how Fero go kon take listin to mi, since I nor dey fit tok well?”
I kon sey, “My own don finish, bikos evry word wey dey komot from my mout, na sin full am and I dey stay with pipol wey all dia words na sin and naw, I don use my eyes si Oga God wey bi di king wey get pawa.”
So I ansa, “My Oga God, I nor sabi tok well and I still yong too.”