20 Amram marry en papa sista, Jokebed and e born Aaron and Moses. (Amram stay for one hundred and thirty-seven years, before e die).
Na Amram born Aaron and Moses. Dem choose Aaron and en shidren-shidren to dey kare for di holy tins; burn incense to take woship God; to dey serve God and dey bless di pipol with God name forever.
Levi shidren akordin to dia rekord na Gershon, Kohat and Merari. (Levi stay for one hundred and thirty-seven years.)
Kohat shidren na Amram, Izhar, Hebron and Uzziel. (Kohat stay for one hundred and thirty-three years.)
Dis na Levi family and dem bi: Libni family, Hebron family, Mahli family, Mushi family and Kohat family. Na Kohat born Amram.
Amram wife name na Jokebed, Levi dota wey dem born for Egypt. Di woman born Aaron, Moses and dia sista Miriam give Amram.
Dis na both Aaron and Moses family afta God tok with Moses for Mount Sinai.
Dem share di first ones give Kohat family. Di Levi wey bi priest Aaron shidren kon get thirteen big towns from Judah, Simeon and Benjamin tribe.