as di yong men advise am. E sey, “My papa give una hard work, but I go make una work, hard pass as e bi before. My papa dey flog una with ordinary kane, but I go flog una with koboko!”
Yu go still tell dem, ‘My papa give una hard work do, but I go make di work hard well-well. Na ordinary kane e take flog una, but na koboko I go take dey flog una!’ ”
Wen Moses don mature, e komot go visit en Hibru pipol. For der, e kon si how en pipol dey sofa, bikos of di work wey dem dey do. Den Moses si as one Egypt man dey beat one Hibru man wey bi en own pesin.