Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 5:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Moses and Aaron kon sey, “Hibru pipol God don show ensef to us. So make yu allow us go di wildaness for three days go do sakrifice to awa God, so dat E nor go kill us with sickness or war.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 5:3
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen dem first rish der, dem nor gri woship God. So God kon send lion go meet and kill some of dem.


Make una nor dey sturbon like una papa, but make una obey God as una dey kom en house wey E don make holy forever. Make una serve am forever, so dat E nor go vex for una.


Yu must do evritin wey God for heaven wont for en temple kon make sure sey, E nor ever vex for mi and doz wey go rule afta mi.


“Di eldas go agri with yu, so yu and di eldas for Israel must go si Egypt king kon tell am, ‘God, wey bi Hibru pipol God don kom meet us. Naw, make yu allow us travel for three days go inside di wildaness, so dat wi go fit go offa sakrifice give di Oga awa God.’


Den yu go tell am, ‘Na Oga God, wey bi Hibru pipol God send mi kom tell yu sey, “Make yu let my pipol go serve mi for di wildaness! But yu nor won gri.” ’


Den God tell Moses, “Go tell Fero sey, ‘Dis na wetin God tok, “Make yu let my pipol go serve mi!


God tell Moses, “Make yu wake-up for early morning go meet Fero as e dey go di river kon tell am, ‘God sey, “Make yu let my pipol go serve mi!


So wi must travel for three days go inside di wildaness go sakrifice to di Oga awa God, just as E don dey tell us since.”


God still sey, “Make yu klap yor hand! Mash di groun well-well! Cry with pain kon sey, ‘Bikos of all di wiked and bad tins wey Israel pipol don do, dem go die for war or honga and diziz go kill dem trowey.


I go ponish una with war, bikos una nor keep di kovenant wey I make with una and if una gada for una towns make una for dey save, I go send diziz wey dem nor dey fit cure among una and una enemies go win una.


God go send diziz kom meet una, until nor of una go remain for di land wey una go soon enter go stay.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ