Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 5:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 sey, “Make God judge una, bikos una don make di king and en workers hate us and una don give dem shance to kill us!”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 5:21
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den Sarai kon tell Abram, “Na yu curse dis wahala for mi! I allow yu make yu sleep with my savant, but as e know sey e don get belle, e nor kom dey respet mi again. Make God judge between yu and mi!”


Abraham and Nahor God, dia grand-papa God go judge between yu and mi.” So Jakob kon swear with di God wey en papa Isaak dey fear


Den Jakob tell Simeon and Levi sey, “Una don turn mi to dirty wey dey smell to di pipol for dis land, Kanaan pipol and Periz pipol, bikos of di wahala wey una put for my head. My pipol nor plenty and if dem gada demsef kon attack mi, dem go distroy both mi and my family.”


Wen Ammon pipol si sey dem don make David vex for dem, dem kon go Aram Bet-Rehob and Aram Zobah go hire 20,000 sojas wey dey waka for groun, plus 1,000 men from Maaka king and 12,000 men from Tob.


Wen King Hanun and Ammon pipol know sey dem don make David dia enemy, dem kon use about 75,000 pound for silva take go hire men from Aram Naharaim, Aram Maaka and Zobah.


Den di pipol tell Moses, “Na bikos grave nor dey Egypt, naim make yu bring us kom inside dis wildaness, so dat wi go die for here? Na wetin make yu karry us komot from Egypt?


So di pipol bigin komplain give Moses sey, “Wetin wi go drink?”


So evribody for Israel kon dey komplain give Moses and Aaron inside di wildaness.


so di pipol bilive Moses. Wen dem hear sey God don kom save Israel pipol and E don si as dem dey sofa rish, dem kon bow woship am.


Afta dem leave Fero, dem kon go meet Moses and Aaron wey bin dey wait for dem kon


Moses tell Israel pipol dis tins, but dem nor listin to am, bikos of dia sofa.


Just as fly wey don die dey make perfume smell, na so too small foolishness dey spoil pesin wisdom and respet.


Dis message na about di animals for Negev: For der, di pipol pak dia propaty and money on-top donkey kon travel pass one land wey wahala and trobol full; where lions, snake and oda wiked animals dey stay. Dem travel go meet pipol wey nor go fit help dem.


I go remove di strong sojas wey kom from nort kon drive dem enter desert. I go drive dia leaders enter Dead Sea and doz sojas wey dey lead dem, I go drive dem enter Mediterranean Sea. Dia dead body go smell well-well. I go distroy dem, bikos of all wetin dem do una.


non of dis pipol go dey alive to enter di land. Dem don si my glory and mirakle wey I do for Egypt and for di wildaness, but dem don too try my patient, bikos dem nor gri obey mi.


Wetin make God bring us kom dis land, so dat dem go kill us for war? Dem go katch awa wifes and shidren go as slaves! E for betta sey wi go Egypt back o-o?”


Israel pipol hear sey Saul don kill Filistia sojas wey gada for Gibeah and Filistia pipol kon hate dem. So all Israel pipol kon go join Saul for Gilgal.


So Akish trust David, bikos e bilive for en mind sey, “Israel pipol really hate David. So from naw go, e go get to stay here kon serve mi forever.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ