Yu go still tell dem, ‘My papa give una hard work do, but I go make di work hard well-well. Na ordinary kane e take flog una, but na koboko I go take dey flog una!’ ”
Israel pipol wey dem take make oga ova dia own pipol kon know sey dem don enter trobol as di king sey, “Una must make di block rish as una bin dey do am.”
Den I tink of all di wiked tins wey dey happen for dis world. I si pipol wey dem dey opress, dey kry and nobody dey to help dem. Nobody dey to save dem from doz pawaful men wey dey opress dem.