Si! Dem bi like grass wey fire burn trowey! Dem nor even fit save demsef, from di fire wey too hot for dem. Wen di weda kold, dem nor get fire to take warm demsef or di one dem go sidan near.
So, as straw and dry grass dey burn for fire, na so too dia life and all di betta tins wey dem get, go dry and blow trowey, bikos dem don rijet wetin Israel God wey get pawa, tish us.
Dem go dey make nois like war horse wey dey run on-top mountin and dia nois bi like dry grass wey fire dey burn. Dem bi like strong sojas wey ready to go fight.
Jakob shidren-shidren go bi fire; Josef shidren-shidren go bi big smoke and Esau pipol go bi like leaf wey fall for groun, dem go burn dem rish groun, bikos God don tok!