Den God go kover and guide Mount Zion with all di pipol wey gada der with kloud for day time and fire for nite. Yes! God glory go kover and protet di whole town.
Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.
“Make yu tell yor broda Aaron sey, na di rite time e go-go di place wey holy well-well for di curtain back, bikos na for der I appear for kloud on-top di Kovenant Box. If e nor do am, e go die.
For di day wen dem build di Tabanako finish, di kloud kon kover di Tabanako and di Kovenant Box and from evening go rish morning, di kloud bi like fire for evriwhere for di Tabanako.