30 Den e put di basin between di tent where dem for dey do meetin and di altar kon pour wota inside to take dey wosh.
E make di bronze basin and en bronze stand from di mirror wey bilong to di wimen wey dey serve for di Tabanako gate.
E still put burnt ofrin altar for di Tabanako gate, di tent where dem for dey do meetin kon put di burnt ofrin and food ofrin for top, just as God kommand.
Moses, Aaron and en sons go wosh dia hand and leg for inside.
And yu go put di basin between di tent where dem for dey do meetin and di altar, den pour wota inside.
I go pour klean and good wota for una body, so dat una go dey klean from di juju wey una dey woship before and evritin wey make una dirty.
So make wi draw near God with betta heart and strong faith, bikos God don wosh awa heart and body with klean wota.