28 Den e put di curtain for di Tabanako door.
den di incense wey get good smell, e kon burn am put, just as God kommand.
E still put burnt ofrin altar for di Tabanako gate, di tent where dem for dey do meetin kon put di burnt ofrin and food ofrin for top, just as God kommand.
“Yu go put gold altar for di incense for di Testimony Box front kon put di curtain for di Tabanako gate.
Na mi bi di door, anybody wey enter thru mi, God go save am. E go-go inside and out and e go si betta grass chop.
Jesus ansa am, “Na mi bi di road, di trut and life. Nobody go fit go meet my Papa, unless e pass thru mi.
so dat thru am, all of us with one Spirit, go fit rish where awa Papa dey for heaven.