15 kon anoint dem, just as yu anoint dia papa make dem for fit serve as my priests too and dia anointin go make dem kontinue di work thru-out dia generashon.”
God don promise and E nor go break di vow wen E make sey: “Yu bi priest forever like Melkizedek.”
Una go dey remember dis day and celebrate am to di Oga una God forever.
Yu go wear dem give Aaron yor broda and en sons. Yu go anoint, klean and santify dem, so dat dem go fit serve as my priests.
Put sash round dia waist kon wear head-band for dem, so dat dem go serve as priest, just as God kommand dem. Na so yu go take klean Aaron and en sons.
Make yu tell Israel pipol, ‘Una go always dey use dis holy anointin oil anytin una dey do God work.
Anybody wey make perfume like am or take am rub strenja, dem go drive am komot from di kommunity.’ ”
Yu go bring en sons, dress dem with tunik
Dis na wetin Moses do akordin to evritin wey God kommand am.
Den e tell mi, “Na dem bi di two pesin wey dem anoint for heaven to serve Oga wey bi God for di whole eart.”
Na en get am and en shidren go bi priest forever, bikos e take en God sirious kon make mi forgive dis pipol.’ ”
E nor get papa or mama, e nor get story at-all, en days nor get where e for start or where e go end, but e bi like Man Pikin and e bi priest forever.
True-true, wi know sey pesin wey bless pesin, na-im big pass di pesin wey e bless.