7 God tell am, “Put yor hand back inside yor dress.” So e put am back, den e bring am kom out and di hand kon dey okay again.
So Naaman go wosh ensef inside Jordan River seven times, just as God profet kommand am. Afta di sevent time, en skin kon smooth like small pikin own.
So God sey, “If dem nor bilive yu or bilive di first sign, dem go bilive dis sekond one.
Jesus tosh di man kon sey, “Yes, I wont make yu well!” At wons, di sickness komot from di man body.
As e dey enter one village, ten men wey get leprosy meet am for road. Dem stand for far,
God sey, “Na Mi, bi Mi! And e nor get any oda god escept Mi. I dey kill and give life, I dey make pesin sick and heal pesin too and nobody go fit fight mi.