Den God tell Moses, “Make yu klimb kom meet mi; both yu, Aaron, Nadab, Abihu and di seventy eldas for Israel and wen una still dey far from where I dey, make una bow woship mi.
“So make yu go gada di eldas for Israel kon tell dem sey, ‘God wey bi una grand-grand papa dem, Abraham, Isaak and Jakob God appear to mi kon sey, “I don kom meet una and I si as una dey sofa.