20 Den Moses take en wife and pikin, karry dem put on-top donkey kon go Egypt. Moses hold di stik wey God gi-am for en hand.
But make yu yorsef raiz yor stik kon take am divide di Red Sea, so dat Israel pipol go waka pass for dry groun.
So Moses tell Joshua, “Make yu go choose some men for us, so dat una go-go fight Amalek pipol. Tumoro, I go stand on-top di hill with God stik for my hand.”
But e first send message to Moses sey, “I dey kom with yor wife and yor two pikin.”
Moses wife born boy and Moses koll am, “Gershom” bikos e sey, “Na strenja I bi for dis land.”
Yu go still karry di stik follow body, bikos naim yu go take do many signs and wonders.”
So God ask Moses, “Wetin dey yor hand?” E ansa, “Na stik.”
Den Moses raiz en hand kon nak di rock two times with en stik. Plenty wota rush kom out, den evribody for Israel and dia animals kon drink beleful.
Wen di man tok like dis, Moses run go Midian, anoda land where e stay as strenja kon born two boys for der.