“Make yu still make di Tabanako with ten curtain with fine linen wey dem weave with blue, purpol and red wool. Make yu make di curtains like angel wey get feada and na who dey design go do dis work.
Na di kind garment wey dem go make bi dis: e go get chest kover, one priest garment, one robe, tunik wey get design, one priest kap and sash. Dem go still make special garment for Aaron sons wey dem go wear kon serve mi as priest.
E go wear good judgement for body like war koat kon wear viktory like priest kap for en head. E go wear klot wey go make am do good tins kon ponish doz wey dey sofa pipol.