3 Dem melt di gold kon turn am to flat shit, den kut am small-small, so dat dem go weave dem to di blue, purpol and red wool with fine linen and dis na di artist work.
“Make yu still make di Tabanako with ten curtain with fine linen wey dem weave with blue, purpol and red wool. Make yu make di curtains like angel wey get feada and na who dey design go do dis work.
All di pipol wey sabi work, make ten curtain for di Tabanako with fine linen wey dem weave with blue, purpol and red wool kon design am with image wey bi like angel.