E still make one bronze basin kon koll am “Di Sea.” If dem measure am from one side to di oda, na 15 fit e bi; e round for shape kon high rish seven and half fit. Di basin round rish 45 fit.
God sey, “For dat day, I go open one place where wota go for rush kom wosh David shidren-shidren and Jerusalem pipol from all dia sins and all di bad-bad tins wey dem dey do.
But Simon Pita stand outside di kompond near di door. Den di oda disciple wey know di High Priest kom out kon tok to di savant girl wey dey guide di gate and e kon allow Pita enter inside.
To chop, drink and to do serimony take klean pesin body, na-im koncern dem. All dis one na rule for dis world, until di time wen God go bring di new law.
So my shidren, make una nor let anybody deceive una: If pesin dey do wetin good for God eye, dat show sey dat pesin dey good, just as Christ dey good for God eye.
and from Jesus Christ, di witness wey dey tok trut; di first-born among doz wey God raiz from deat and naim bi di King of all kings. Christ wey love and free us from awa sins with en own blood;
Naw, wen Eli don old well-well, e kon dey hear evritin wey en boys dey do to evribody for Israel and how dem dey sleep with wimen for di temple door-mot.