28 From di 1,775 shekel wey remain, Bezalel make hooks for di posts kon kover dia top, den e make rod for dem.
All di post wey dey inside di kourtyard go get silva rod and dem go use silva take make dia hook kon stand dem on-top di bronze.
Na one hundred talent of silva dem use take make di stand for di Tabanako and di curtain; one hundred stand na for one hundred talent; while one talent na for each stand.
Di bronze from di ofrin na seventy talent and 2,400 shekel.