12 For di west side, di curtain long rish seventy-five fit, with dia ten posts; di ten stand; dia silva hooks and rods.
Make yu guide dem with twenty bronze post kon put dem on-top anoda twenty bronze stand, den hang di curtains with silva hook wey dem join with di silva rod wey join di post.
For di nort side, di curtain na one hundred and fifty fit, with dia twenty post, dia twenty bronze stand, silva hooks and rods.
Den for di east side where di sun from dey raiz, di curtain wide rish seventy-five fit too.