3 E make four gold rings kon tie dem for di four korna with two ring for one side and anoda two ring for di sekond side.
Levi pipol karry di box for pole kon put am for dia shoulder, just as God kommand thru Moses, en savant.
Di angel image feada kover di place where dem put di box. Di angel wey dem karve, kover di box and en poles.
E wrap am with pure gold, both for inside and outside. Den e take gold make borda round am.
Den e use akasia wood take make poles kon wrap dem with gold.
I kon ansa, “My oga, na yu know di ansa.” Den e sey, “Dis pipol die bikos of Christ. Dem don use di Lamb blood take wosh dia klot, naim make am white like dat!