18 Di lampstand get six branches wey kom out from all en side; tree branches from each side.
Di lampstand go get six side: from en leg, three go dey one side and anoda three go dey di oda side.
Bezalel melt pure gold take make di lampstand. E make all di lampstand with en dekorashon with one material; di bottom, en shaft, en cups, di fine flower, en small-small seed and di petal.
Each of di six branches get three cup wey dem design like flower wey get small-small seeds and dem dey shine.
“Go tell Aaron sey make e put di seven lamp for where di lite go for dey shine for di lampstand front.”