“Make yu still make di Tabanako with ten curtain with fine linen wey dem weave with blue, purpol and red wool. Make yu make di curtains like angel wey get feada and na who dey design go do dis work.
“Make tailor wey sabi design klot, design di chest side wey dem go wear wen dem won go know God mind. Make yu make am like priest garment material: wey bi fine linen wey dem weave with gold, blue, purpol and red wool.