Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 34:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 kon sey, “My Oga God, if I really dey good for yor eye, make Yu go with us, bikos wi bi sturbon pipol; make Yu forgive us awa evil and sin kon take us as yor pipol.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 34:9
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

True-true, God don choose Jakob as en own and Israel pipol as en own pipol.


My God, bikos of di honor wey yor name get, make Yu forgive mi my many-many sins.


So God, make Yu save yor pipol! Make Yu bless Israel pipol wey bi yor special propaty. Make Yu guide dem like shepad kon karry dem for yor hand forever.


Si as blessing full di nashon wey God bi dia God, bikos God don take dem as en own.


E give en pipol to enemies make dem kill dem with swod, bikos E dey vex well-well with di pipol wey E love well-well.


God nor go rijet en pipol; E nor go leave di pipol wey E love well-well.


And naw, if una go obey and keep my kovenant, una go bi special pipol wey I selet from di oda pipol for dis world, bikos na mi get di whole world.


Den God sey, “I don si how dis pipol sturbon and nor dey hear word.


Moses kon tell God, “Si, Yu don dey always tell mi sey, ‘Take dis pipol go dat land,’ but Yu neva let mi know who Yu go send follow mi. But Yu sey, ‘I know Yu by yor name and Yu always dey good for my eye.’


I dey keep my promise to tazon generashons. I dey forgive evil and sins. But I nor go fail to ponish wiked pipol with dia shidren-shidren. I go ponish di third and fourt generashon, bikos of wetin dia papa do naw.”


Bikos I know how una sturbon rish; una neck strong like iron and una head bi like bronze.


Jakob God nor bi like dem; na-im kreate evritin and E don choose Israel as en own pipol. En name na God wey dey mighty.”


E nor get anoda god like Yu; Yu dey forgive yor pipol wey survive. Yu nor dey vex forever, instead, Yu dey happy to show yor pipol yor love wey nor dey end.


Judah go bi God special propaty for en holy land again, den Jerusalem go bi di town wey God choose.


Abeg, make Yu forgive dis pipol akordin to yor love wey nor dey shange; wey strong well-well, just as Yu take forgive dem for Egypt kon rish naw.”


dey tish dem to do evritin wey I tish una. I go always dey with una until di world go end.”


Na God get di pipol for Israel; na Jakob bi en special propaty.


Make una remember sey di Oga wey bi una God, save and take una komot from Egypt, so dat una go bi en own pipol wey E go guide and na so una bi till today.


Den I go stay for God present for anoda forty days and forty nite; I nor chop or drink anytin bikos of all di sins wey una don kommit wen una dey do wiked tins wey go make God vex well-well.


I pray to am, “My Oga God, make Yu nor distroy yor pipol wey bi yor betta propaty; pipol wey Yu save with yor own pawa kon take dem komot from Egypt with yor strent.


Dem bi yor pipol, yor betta propaty wey Yu take komot Egypt with yor great strent and pawa.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ