4 So for early morning, Moses kut two stones like di first ones kon klimb go Mount Sinai, just as Oga God kommand am and e karry di two stones follow body.
God kom on-top di mountin kon sey make Moses kom meet am for der, so Moses kon go up.
God koll Moses from di mountin kon tell am, “Dis na wetin yu go tell Jakob house and Israel pipol:
Naw di stones dem na God word and na God rite wetin dey inside di two stones.
God kon tell Moses, “Make yu kut two stones kom out like di first ones wey yu skata, den I go rite di same word put for dis ones.
For dat time, God kon tell mi, “Make yu kut two stones like di first ones den kom meet mi for di mountin; make yu still make box with wood for yorsef.
So I use akasia wood take make box kon kut two stone like di first ones. Den I klimb go di mountin with di two stones for my hand.