2 Ready for morning den make yu klimb go Mount Sinai go wait for mi.
and ready for di third day, bikos for dat third day, I go kom from Mount Sinai and all di pipol go si mi.
Smoke kover Mount Sinai, bikos God land on-top di mountin with fire. Di smoke dey go up like oven own and di mountin kon dey shake well-well.
God kom on-top di mountin kon sey make Moses kom meet am for der, so Moses kon go up.
But God tell Moses, “Make yu go down, den kom back again with Aaron, but nor let any priests or di pipol waka pass or near di mountin, bikos I go ponish dem.”
Den God tell Moses, “Make yu klimb di mountin and I go give yu di law and kommand wey I rite for small flat stone, so dat yu go fit tish di pipol.”
I liedan for groun for God present for forty days and forty nite, bikos E sey E go distroy una.