God go shake Israel land like wood wey dey float for wota. E go rut Israel pipol komot from dis good land wey E give dia grand-grand papa kon skata dem pass Eufrates River, bikos dem don make am vex as dem make Asherah juju kon dey woship am.
E ansa, “My Oga God wey get pawa, na only Yu I dey serve, but Israel pipol don break di kovenant wey dem make with Yu. Dem skata yor altar kon kill all yor profets. Na only mi remain and dem won kill mi too!”
God ansa, “I go make all my goodness pass yor front and I go announce my name as Oga God to yu. I go show kindness to who I choose and I go show mesi to who I like show am to.”
Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.
Bikos dem don born one pikin for us! God don give us boy pikin! E go bi awa ruler and dem go koll am, “Wonderful Advise, Mighty God, Everlastin Fada and di Prince wey bring peace.”
Bikos I dey vex for yu, I go let dem ponish yu as dem dey vex. Dem go kut yor nose and ear komot and dem go kill yor shidren. Yes! Dem go take yor shidren from yor hand kon burn dem alive.
Dem don make mi dey vex for di gods wey dem dey serve; dem don make mi dey vex well-well with tins wey nor mean anytin: So, I go make dem jealous doz wey nor bi human being: I go make dem vex well-well for kountry wey nor get sense.
Dem kon sey, “Di Oga awa God don show us as en glory big rish and wi don hear am tok from inside di fire. Naw wi don know sey God fit tok to human being and dem go still dey alive.
bikos di Oga una God wey dey here with una, dey jealous well-well and en vexnashon go kill and porshu evry oda tin, until E go distroy wiked pipol and sinnas komot from dis eart.
Joshua kon warn di pipol, “Una nor go fit dey woship God as E wont, bikos E dey holy. E dey jealous and E nor go forgive una if una turn from am kon sin.
Den I tell una sey, “Na mi bi una Oga and God. Una must nor woship Amor pipol gods; even doh una dey stay dia land naw.” But una nor gri listin to mi.’ ”