Dia Oga wey bi dia grand-grand papa God, dem leave en temple kon bigin woship Asherah and difren juju. Bikos of dia sin, God kon dey vex for Judah and Jerusalem pipol.
una must drive all di pipol wey dey stay di land komot. Make una distroy all dia juju wey dem make with stone or iron and all di place where dem for dey woship di juju.
If una distroy dem finish, di pipol for di land nor go dey to tish una how to serve and woship dia own gods and juju wey go make una sin against di Oga una God.
All di kountries wey di Oga una God dey give una, una must distroy all of dem finish. Make una nor sorry for dem at-all and make una nor woship dia gods, if not dem go trap una.
Den I tell una sey, “Na mi bi una Oga and God. Una must nor woship Amor pipol gods; even doh una dey stay dia land naw.” But una nor gri listin to mi.’ ”
So Gideon make image with di gold kon put am for Ofrah wey bi en own town. Israel pipol forget God kon go der dey go woship di image. And e kon turn wahala for Gideon and en family.