8 Wen Moses go di tent, all di pipol go get up kon stand for di gate for dia tent door and dem go dey look Moses until e enter di tent.
Moses take di tent kon stand am for outside for di place wey far pass for di kamp and e koll am, “Di tent where dem go for dey meet.” Anybody wey won si God, go-go di tent for outside di kamp.
Anytime Moses enter di tent, di pila with kloud go kom down kon stand for di gate and God go tok to Moses.
So dem komot from Korah, Datan and Abiram tent. Den Datan and Abiram kom out kon stand for di tent door-mot with dia wifes and shidren.