Oga wey bi di God for heaven wey take mi komot from my papa house and di land wey my pipol dey, naim promise mi wen E promise sey, ‘I go give dis land to yor shidren-shidren.’ So God go send en angel go for yor front, so dat yu go si one good wife for der kon bring kom give my pikin.
I don promise sey na from Egypt where una dey sofa naw, I go for take karry una go take-ova Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol land, di place where milk and honey full.” ’
I don kom diliver dem from Egypt pipol, den karry dem go anoda land wey dey good and big. Di land wey milk and honey dey flow for di aria where Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol dey stay.
Naw make yu dey go; karry di pipol go di place wey I bin tell yu! Si, my angel go lead yu. Wen di day rish wen I go judge each pesin akordin to wetin e do, den I go ponish evribody for dia sin.”
Moses kon tell God, “Si, Yu don dey always tell mi sey, ‘Take dis pipol go dat land,’ but Yu neva let mi know who Yu go send follow mi. But Yu sey, ‘I know Yu by yor name and Yu always dey good for my eye.’
Bikos una dey kom meet mi di Oga una God three times evry year, I go drive di pipol for doz kountry wey won stop una and I go make una land big; so dat nobody go fit take una land.
For dat time, God go protet doz wey dey stay Jerusalem and even doz wey weak pass among dem, go dey strong, just as David, dia grand-grand papa bi. David shidren-shidren go lead dem like God angel and dem go bi like God.
Di Oga una God go-go for una front and na small-small E go take porshu doz pipol komot di land for una, until dem go finish. E nor go porshu all of dem at wons, if not wild animals go kon too kwik plenty for di land before una rish der.
“ ‘Una cross Jordan River kon rish Jeriko. Di leaders for Jeriko, plus Amor, Periz, Kanaan, Hit, Girgash, Hiv and Jebus pipol kon fight una, but I make una win all of dem.
Joshua sey, “Na like dis una go take know sey, God wey nor dey die dey with una and E go really porshu Kanaan, Hit, Hiv, Periz, Girgash, Amor and Jebus pipol komot for una.