Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 32:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Den God sey, “I don si how dis pipol sturbon and nor dey hear word.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 32:9
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But una nor gri listin, instead una dey show strong head like dia grand-grand papa wey nor trust di Oga dia God.


Make una nor dey sturbon like una papa, but make una obey God as una dey kom en house wey E don make holy forever. Make una serve am forever, so dat E nor go vex for una.


But bikos of pride and sturbones, awa grand-grand papa dem nor gri obey yor kommand.


Dem nor gri obey; dem forget all wetin Yu don do; dem forget di mirakles wey Yu do and bikos of dia pride, dem choose leaders wey take dem go back to Egypt as slave. But Yu bi God wey dey forgive. Yu dey good and dey sorry for pesin. Yu nor dey kwik vex and yor royal love nor dey fail. Yu nor abandon dem at-all


Dem nor go bi like dia grand-grand papa wey sturbon; pipol wey nor gri obey, listin or give dia heart to God.


Una dey go di land where milk and honey full. But I nor go dey with una, bikos una bi sturbon pipol and if I travel with una, I fit go distroy una for road.”


God tell Moses, “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Una too sturbon. So, if I go with una, I fit vex distroy una. Naw make una remove all una gold and fine klot, even doh I still dey tink wetin I go do with una.’ ”


kon sey, “My Oga God, if I really dey good for yor eye, make Yu go with us, bikos wi bi sturbon pipol; make Yu forgive us awa evil and sin kon take us as yor pipol.”


If yu nor dey gri take korreshon, one day yu go fall and yu nor go fit stand again.


Bikos I know how una sturbon rish; una neck strong like iron and una head bi like bronze.


Jerusalem pipol! I don si as una dey do ashawo waka and as una dey run follow difren juju for fields and for evry hill. Naw, make una si di wahala wey dey wait una. So, una go ever dey klean to woship mi again?


I don si wiked tins for Israel: Judah pipol don make demsef dirty, bikos dem dey woship juju.


Den God tell Moses, “How long my pipol go rijet mi? Dem nor go ever bilive mi, even afta all di signs wey I don do for dia present?


“Si how una sturbon! Just as una grand-grand papa dem bi, na so una still bi too, bikos una don make una heart strong to disobey God!


So make una shange una heart and stop to dey do strong head.


bikos I know as una sturbon rish. True-true, as I stay among una kon rish today, una still dey disobey God; so how una sturbones go kon bi wen I don die?


God still sey, “I don si sey dis pipol sturbon well-well!


So make una undastand naw sey nor bi bikos una good make di Oga una God dey give una dis land, bikos una nor good and una bi sturbon pipol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ