6 Di pipol wake-up di next day to offa burnt and peace ofrin. Afta dis, dem celebrate kon dey chop and drink, den dem start to do wetin God sey make dem nor do.
For where dem for dey woship, dem dey kover diasef with klot wey dem kollect from poor pipol as payment for debts. For inside God temple, dem dey drink wine wey dem kollect from doz wey dey whole dem money.
“I go turn una festival to burial kon shange una happiness to kry. I go make una kut una hair kon wear sak klot, den I go make una mourn like sey una only pikin just die. Dat day go bitter well-well.