Den God tell Moses, “Make yu rite dis tin for groun, so dat pipol go remember am, den tell Joshua sey, mi wey bi Oga God go make sure sey Amalek pipol nor go dey dis world again.”
Na di pesin wey sin, go die. Pikin nor go sofa, bikos of en papa sin and papa nor go sofa, bikos of en pikin sin. Pesin wey good, God go pay am for en goodness, but wiked pesin go sofa di wikedness wey e do.
Yes, my good friends, I still dey tell una, make una help dem. Dem try as dem dey prish di gospel with mi, both Klement and my oda ko-workers, wey dia name dey inside Christ Life Book.
And I si di pipol wey don die, both big and small, as dem stand for di throne front. Dem open plenty books and den kon open anoda book wey bi di Life Book. And dem judge doz wey don die akordin to wetin dem rite for di books sey dem do.
Anybody wey fit bear rish di end, go wear white klot like dem and I nor go remove en name from my Life Book, but I go tok about am for my Papa and en angels front.