Di king nor kon happy again. So e go di room wey dey di gate side kon bigin kry. As e dey go, e dey kry sey, “O-o! My pikin Absalom! Absalom my pikin, e for betta sey na mi die, instead of yu!”
I go soon ponish una wey bi lie-lie profets, bikos wetin una dey tok, dey skata pipol. Una nor go dey der wen my pipol go gada make decision; una name nor go dey among Israel pipol and una nor go ever kom back to di land. Den una go know sey na mi bi God.
“Den Mikael; di great prince wey dey guide yor pipol, go appear. Dat na wahala time and dis kind wahala neva happen for anywhere kom rish naw. But yor own pipol wey dia name dey di book wey get life, go eskape.
For my vishon, I si di lokust dey chop all di plant wey dey grow for di land, so I sey, “God wey get pawa, I beg, make Yu forgive us; wi nor go survive dis wahala bikos wi nor plenty and wi weak well-well.”
Den di pipol wey dey fear God kon tok to each oda and God listin and hear wetin dem tok. For God present, all doz wey dey fear and respet en name, dem kon rite dia name put for one book so dat God go remember dem.
Oga God sey, “Dem go bi my pipol. For di day wey I go kom judge di world, na dem go bi my own. I go sorry for dem, just as papa dey sorry for en pikin wey serve am.
God kom down for di kloud kon tok to dem. E take some of di Spirit wey dey inside Moses kon put dem inside di seventy men. Wen di Spirit enter dem, dem kon dey profesai, but dem nor do like dat again.
So wen di Oga una God don give una rest from all una enemies for di land wey E promise una, una must distroy Amalek pipol finish for dis world and nor of dem go remain.
Yes, my good friends, I still dey tell una, make una help dem. Dem try as dem dey prish di gospel with mi, both Klement and my oda ko-workers, wey dia name dey inside Christ Life Book.
Di beast wey yu si, dey before, but e nor dey again and e go soon raiz kom from di pit kon start to distroy. Den doz pipol for eart wey dia name nor dey for di Life Book, go fear di beast.
But know dirty or yeye tin go ever enter di town. Pesin wey dey do bad or dey lie, nor go ever enter der, but di pipol wey go enter, na only doz wey dem rite dia name for di Lamb Life Book.
And if anybody remove any word from dis profesy book, wetin suppose bi en own for di tree wey dey give life and for di holy town wey dem diskribe for dis book, God go take am from am.
Anybody wey fit bear rish di end, go wear white klot like dem and I nor go remove en name from my Life Book, but I go tok about am for my Papa and en angels front.