29 Den Moses tell Levi pipol, “Today, una don prepare unasef as priest to serve God, bikos una obey am even doh una nid to kill una sons and brodas. So God don bless una.”
E still tell Levi pipol wey bi tisha for Israel about di tins wey dem dedikate give God sey, “Di holy ark wey Solomon, King David pikin build, make una put am for di temple. Make una nor put am for una shoulder. So, di Oga wey bi una God, na-im and en pipol Israel, una go serve!
But if anybody still get di mind to lie sey e dey profesai, na en own papa and mama go tell am sey, ‘Na deat go bi yor own, bikos yu dey lie with God name.’ Den if e still profesai, en papa and mama go shuk am die with swod.