Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 32:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 So Moses stand for di kamp gate kon shaut sey, “If yu dey God side, make yu kom meet mi.” Den Levi tribe gada go meet am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 32:26
8 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

One of Joab men stand near Amasa dead body bigin shaut, “All di pipol wey dey Joab and David side, make una follow Joab!”


Jehu look up kon shaut, “Na who dey my side?” Like two or three kourt ofisas look am from di window.


Naw, who go protet mi from wiked pipol? Who go help mi fight doz wey dey do evil?


Moses si sey bikos of Aaron, di pipol nor fit kontrol diasef again and dia enemies dey laf dem.


Moses tell dem, “Di Oga wey bi Israel pipol God sey, ‘Make evribody karry dia swod, bigin kill each oda thru-out di kamp. Make una bigin kill unasef, brodas, friends and neighbours.’ ”


“Anybody wey nor dey with mi, dey against mi and anybody wey nor join mi, dey skata my work.


Dem tell dia papa and mama sey, ‘Wi neva si am’ and e nor do like sey e know us or en own shidren, bikos dem keep yor word kon guide yor kovenant.


Wen Joshua don near Jeriko, e look up kon si one man stand for en front and di man hold swod for hand. Joshua waka go meet am kon ask, “Yu dey with us, abi yu dey against us?”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ