23 Dem tell mi sey, ‘Make yu make god wey go lead us, bikos wi nor know wetin don happen to Moses wey take us komot from Egypt.’
Dem kwik-kwik turn komot from di way wey I kommand dem o-o! Dem melt gold take make melu for demsef and dem don dey bow and offa sakrifice to am sey, ‘Israel pipol, dis na awa god wey take us komot from Egypt.’ ”
Dem kon tell Aaron, ‘Make yu do juju for us wey go lead us bikos, wi nor know wetin don happen to Moses!’
Saul ansa, “I bring dem kom from Amalek; di sojas keep di best for di animals, so dat dem go sakrifice am to God. But wi kill evry oda tin.”
But di sojas take some for di best animals and tins, so dat dem go sakrifice am to di Oga yor God for Gilgal.”