Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 32:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Moses kom down from di mountin with di two kommandment stones for en hand. God rite for di two side for di stones.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 32:15
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God laws dey korrect and e dey save life. Di laws wey God give us na trut and dem dey give wisdom to pipol wey ready to learn.


Just as God kommand Moses, Aaron kon put am for di Kovenant Box front, so dat e go dey save.


Den God tell Moses, “Make yu klimb di mountin and I go give yu di law and kommand wey I rite for small flat stone, so dat yu go fit tish di pipol.”


Moses enter inside di kloud wen e klimb di mountin and e stay der for forty days and forty nites.


Wen God don tok to Moses finish for Mount Sinai, E kon gi-am two stones wey E rite di kommandment put.


Naw di stones dem na God word and na God rite wetin dey inside di two stones.


Wen Moses kom down from Mount Sinai with di two stones wey dem rite di kommand put, Moses nor know sey en face dey shine as e dey tok with God.


E take di testimony stones kon put am inside di box, tie di poles for di box, den put di kover on-top.


E klear sey na Christ rite dis leta by ensef kon send am thru us. Nor bi biro dem take rite am, but na di God wey dey alive Spirit dem take rite am, nor bi for paper, but na for awa heart.


Di ministry wey dem rite for slate bring deat kom and di glory wey follow am, nor let Israel pipol fit look Moses face. If di glory wey dey Moses face, fade bikos e dey under di law,


God tell una dis tins from inside di fire as una gada for di mountin. E shaut tok from di fire wey kloud and darkness kover. Dis na all di tins wey E tok dat time and E rite dem for two stones kon give dem to mi.


So I turn komot di mountin as di fire still dey burn and di two kovenant stones dey my hand.


Di gold altar where dem dey burn incense and di Kovenant Box wey dem kover with gold, dey der too. Di gold jug wey dem put manna, Aaron rod wey grow leaf and di flat stone wey dem rite di law put, dey inside dis box.


Den I si sey di Pesin wey sidan for di throne, hold one book for en rite hand. Dem rite sometin put for di front and back kon lock am with seven keys.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ