7 di Tabanako; di Testimony Box; di atonement box kover wey dey on-top; all di tins wey dey inside di Tabanako;
All di pipol wey sabi work, make ten curtain for di Tabanako with fine linen wey dem weave with blue, purpol and red wool kon design am with image wey bi like angel.
Bezalel make di box with akasia wood; e long rish three fit nine inches kon wide rish two fit three inches and e high rish two fit three inches.
E still make di kover with pure gold and e long rish three fit nine inches kon wide rish two fit three inches.
So dem kon finish di Tabanako work and di tent where dem for dey do meetin. Israel pipol do just as God kommand Moses.
Den God tell Moses:
Yu go put di Testimony Box inside kon kover di box with curtain.