Afta I don bring Israel pipol kom back to dia land, dis na di new kovenant wey I go make with dem: I go put and rite my law for dia heart. I go bi dia God and dem go bi my pipol.
E klear sey na Christ rite dis leta by ensef kon send am thru us. Nor bi biro dem take rite am, but na di God wey dey alive Spirit dem take rite am, nor bi for paper, but na for awa heart.
So di same word wey bi di ten kommandment wey E tell mi for di mountin and from di fire wen una gada go meet am, God kon rite dem put for dis ones as E bin rite am for di first stones.
God tell una dis tins from inside di fire as una gada for di mountin. E shaut tok from di fire wey kloud and darkness kover. Dis na all di tins wey E tok dat time and E rite dem for two stones kon give dem to mi.
Di gold altar where dem dey burn incense and di Kovenant Box wey dem kover with gold, dey der too. Di gold jug wey dem put manna, Aaron rod wey grow leaf and di flat stone wey dem rite di law put, dey inside dis box.