Bikos na six days God take make heaven, eart and all di tins wey dey inside dem and E rest for di sevent day. So God bless di Sabat Day kon make am holy.
“Go tell Israel pipol sey, ‘Una must keep my Sabat Day, di day wey I dey rest, bikos na sign between mi and una thru-out una generashon and e dey show sey na mi bi di God wey choose una.
God sey, “If una keep di Sabat Day holy and una nor run follow wetin una wont dat day; if una value my holy day and honor am and una nor travel, work or tok yeye word for dat day,