Moses ansa, “Dis na wetin God tok: ‘Tumoro na Sabat Day, so evribody must rest. Anytin wey una won bake or boil, make una bake and boil dem today and anytin wey remain, make una keep am till di next day wey bi Sabat Day.’ ”
God wey get pawa sey, “For di six days for di week wen una take dey work, make dem dey always klose di east gate wey dem dey pass enter di kourtyard, but make dem open am for Sabat Day and for di New Moon Festival.
“Dis na di law wey una go obey forever. For di tent day for di sevent mont, Israel pipol and di strenjas wey dey stay with dem must fast and dem must nor do any work.
Dat day na Sabat Day, so una must rest and una must honbol unasef for di ninet day for di mont for evening and from dat evening still di next morning, una must respet di Sabat Day.”
But di oga for di sinagog vex sey Jesus heal pesin for Sabat Day, so e kon tell di pipol, “Wi get six days wen pipol suppose work, so make una kom make dem heal una for doz six days, but nor bi for Sabat Day.”